Hafrik Communitity
This week I go deliver one small engine part for one oga near Guangzhou University, that Panyu side. As I dey wait make e come collect am, I sit down for one canteen wey full of African students. Na there I see say student life for here no be small thing. One boy from Ghana dey sell phone cases on top table, another babe dey do hair for corner. Dem no dey just read book — dem dey hustle RMB make school fee complete. One of dem even ask me how much be landed cost to ship one Tokunbo Camry to Lagos, say na after graduation plan. I look am, tell am straight: oga, first graduate, then come find me. But I like the energy. If you dey school here, no waste this China opportunity. E go work if you get sense.
Like
1
49 المشاهدات