I dey drink that ginger tea for the shop near Sanyuanli today, one small boy come show me video of one 'African tech founder in Shenzhen.' I dey look am, the guy dey talk about 'scaling across Asia.' Omo, nobody ask am how much e pay for that shiny office? Because me I know say for Guangzhou here, even that small warehouse for Baiyun don chop my three months profit before I arrange one container.
I dey think about all the African entrepreneurs I know for this China. Tunde wey dey ship containers of phone accessories, e get ulcer because of agent wahala. That Rwanda sister for Foshan, she dey manufacture furniture but she still dey sleep for factory sometimes to supervise production. E no be startup story dem dey write for TechCrunch o. Na blood and swear. 😂
But truth be say, if you dey here dey hustle legitimate, whether na car parts like me or that crypto app wey I no understand, you get liver. Because this China no send your passport. You fit lose everything one Thursday afternoon because one supplier change price last minute.
Make nobody tell you say e easy. But if e easy, everybody for do am.

237 Vues