Hafrik Communitity
I carry one oga from Lagos go that African spot for Dengfeng yesterday, after we don waka Baogang motor market finish. The man order pounded yam and egusi, chop like say e dey Iya Biliki backyard. But when bill land — ¥75 for plate — e shout say 'Tobi, you sure say this one no be Lekki Phase 1?' 😂

I laff small. Oga, that goat meat cross two border plus airline ticket. The woman wey cook am dey renew visa every six months, rent for that kitchen pass two container for Apapa. African food dey China well well, but no come here dey find ₦1,500 amala. If you wan chop home food, budget am like say you dey source spare part. E go work. 🍲
Like
3
346 Views