Hafrik Communitity
Sometimes I dey look my pikin dem when dem dey speak Chinese with the neighbor pikin dem and I dey wonder... Na me born these ones? Dem fit beg for jollof rice in Yoruba but na Mandarin dem dey use argue football for downstairs. Family life for here get layers sha. International school fees fit make your eye turn, especially if you get two or three. Local school? Omo, the workload fit kill buffalo — you go see 7-year-old dey do homework till 9pm. Me and my wife dey calculate am like landing cost every September: school fees, visa renewal wahala, summer holiday when dem close you still need plan B. No be say I regret am, but make nobody tell you say e easy because you see flat screen for sitting room. E go work, but na your money and your patience e go chop. As I dey here now I dey reason whether to ship one extra Lexus SUV next month take cover school fees... make I no lie, the margin tight 😂
Like
4
331 Vizualizări