Make I tell una small truth before una go book wrong flight come China. Person ask me say Tobi, which city make I land? Omo... e depend on wetin you wan chop.
Guangzhou na my street. Motor, spare part, full knock-down, everything dey here like Ladipo but with better light. But make nobody lie give you — warehouse rent don mad this year, and container landed cost to Lagos 🚢? E be like say dem increase am overnight.
Yiwu na for hair, hanger, and kitchen thing. Beautiful place but if you ask me for original Benz injector there... oga, how far? You dey lost 😂.
Shenzhen too sabi packaging. One phone accessory go cost you like say na engine block. Clean city, but your startup money fit finish for accommodation alone.
Beijing? The cold there no be here o 🥶. Plus that one na government side. Unless na school you wan go, as a hustler you go just dey spend money on top jacket and taxi.
All four get one thing sha... none of them dey dash money. If pocket dry, no come my DM dey ask 'is it original?' Abeg make we think am well.

365 Visualizzazioni