Hafrik Communitity
Make I no lie, sometimes this Guangzhou cold dey make me miss Mama's egusi die. But yesterday I enter one African spot near Xiaobei, them serve me plate of jollof wey look like yesterday's wedding rice then bill me ¥65. Omo, that's like 16k naira. For single plate? E choke 😭. My scholarship no cover lifestyle wahala abeg. Una wey don sabi all the hidden African joints for China, abeg tell me — where I fit chop correct home food without feeling like my account just got hit by my lab supervisor? If you get spot wey dey affordable, rate am out of 10 make I see whether to risk my last tutoring money.
Like
2
314 Vues