Hafrik Communitity
Nna ehn, wahala no dey finish for this Guangzhou o. Yesterday I dey waka go market for Baiyun, minding my own parole, next thing two police guys stop me. Passport! I dey shine teeth bring out my phone show them colored photocopy wey I snap. Omo dem shake head like say I dey speak French. 'You must carry original,' they tell me. My heart cut! See me wey think say phone copy dey enough for this 2024. Dem carry me enter their office small make dem verify my visa. Na there I see say if dem wan serious, na up to 10,000 RMB fine or worse worse. I convert am sharp sharp — that one don pass 1.8 million naira! For just forgetting paper for house? I don learn. If you just land, carry your original passport like your second kidney. And register for PSB within 24 hours if you change apartment, no dull. No be all wahala you go chop with money. Chineke!
Like
4
201 Visualizaciones