Hafrik Communitity
Dating as African for this Guangzhou dey one kain honestly. Last week I carry one fine babe go eat jianbing near the back gate — one portion na ¥12, I convert am for my head, omo na like 2.5k naira. My scholarship no cover romance abeg, Prof Liu dey even wonder why my CFD results dey show insufficient funds.

The wahala no be money alone. You go dey smile when her aunty ask if you get green card plans, meanwhile your brain dey calculate exchange rate. And the language barrier? E choke 😭. She fit post you for WeChat with caption my African boyfriend and you no know if na marketing or love.

Mama call me yesterday dey shout say I don old, say Nneka pikin don marry. Mama, I dey laboratory dey beg ANSYS converge, wetin I know about converge for relationship?

Cheap eat? That jianbing na solid 7/10, the egg almost cover the heartbreak. But dating here? Omo, 4/10. Too much wahala for broke engineering student. 💔
Like
2
22 Visualizações