Hafrik Communitity
Make I drop small fire make una no vex too much — life for China as African soft pass how we dey cry for Twitter and those WhatsApp groups. True true, the language be like bicycle wey no get brake, but the real wahala na our head. We too dey convert everything to naira like say na Jumia we dey. I buy one correct meal for 20 yuan, my brain shout Chineke! Na almost 5k! But omo, forget that thing. You no dey collect salary in naira for here. That same 20 yuan na like 2 hours work if you dey do teaching gig. Back home 5k fit be one week food money, but here? E fit be lunch wey get chicken laps join. Last month I dey price phone accessory for market like say I dey Alaba, I tell the guy tai gui la too sharp, he just look me dey laugh 😂 I forget say I be customer, no be agbero. Rookie error! But since I throw that calculator for dustbin, omo I fit chop two times a day without my chest dey cut. Small win, but I dey celebrate am loud loud! Until you start to dey think in yuan, you go continue to dey suffer inside enjoyment. Abi make I keep quiet?
Like
3
18 Views